Tuax Media Concept

Get all your favourite gospel song lyrics here without stress... We are here for you

Monday 23 July 2018

BENJISZZY - ONE TAP


Verse 1
Which kind life be this wey 
Man pikin no fit dey drink water and drop cup
No be say I no dey
Do my best but as e dey be now nothing don xup 

E dey be like God dey play ojoro, abi we sef no follow? 
To think am sef dey make me feel like say I don dey kolo 

Akpos, e be like i go follow you reason that your matter, I cannot come and kill myself with all this quanta cheiiii

(Hook)

My mama tell me say nah Jesus be the way
But that one no be today e don tey.
Cos with all the kata kata wey man dey face 
Nah to just roll one tap and blow the pain away

(Chorus)

E no concern me If e no good pass me the kpoli
(One tap )
If nah craze make I craze I no send oooh just gimme
(One tap)
I no mind if I go go jail jare just pass me this one tap eh
(One tap)
E be like medicine for the pain oh oh, just gimme
(One tap)

(Verse 2)

Everything don bizzle, I dey for sky level
Shebi nah earth we still dey or nah heaven?

I no know but I like the place I dey
As long as I no dey feel my pain
And if the pain show up I go roll one tap again to maintain my lane

Akpos, e be like you go roll one tap for me again
I need to clear my head from all of this my gbege


(HOOK)
My mama tell me say nah Jesus be the way
But that one no be today e don tey.
Cos with all the kata kata wey man dey face 
Nah to just roll one tap and blow the pain away

(Chorus)

If rizzla no dey use e paper cos all die nah die
(One tap)
E get the way body dey do me baba,
(One tap)
As long as say I no go feel my pain for the now I go high go Spain (One tap)
E be like medicine for the pain oh oh, just gimme
(One tap)

Rap 
Charlie Wey you 
E clear say the problems of life don dey weigh you 
Poverty be like the prison wey dem jail you
Cos day and night you dey shack garri like say you be Shehu

The government no dey help matters
You suppose fall back to family now but nobody get cheddas 
So you carry your last card play 12 games, one game still cut am shebi nah Judas?

The truth be say mehn I’ve been there & done that 
I know how e dey be like believe I no dey run mouth
But that one tap for the pain, go just take you one step closer to the grave 

I no fit lie for you baba, you know say you be my real G, carry your problems give baba Na Him be the real G 
Wey go take all the pain & the sorrow away
You go smile again e no go tey baba

Hook
No be lie wey your mama talk when she say nah Jesus be the way
And em no be just the way
Nah only am fit take your pain away
Cos with all the kata kata wey man dey face 
Nah to carry body gum the person wey fit help you run your race 

Every other way nah story
I no fit lie for you my hommie, forgetii kpoli 
One tap fit make you enter one chance
SAY NO TO DRUGS

No comments:

Post a Comment